How to enjoy wetin lemongrass dey do for body

Lemongrass

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Author, Isidore Kouwonou
  • Role, BBC Afrique

Lemongrass wey dem dey call Indian verbena na type of tropical herb plant fron di Poaceae family.

Dem dey plant am sake of say di stem and leaves get obgbonge smell. Di scientific name of di plant na cymbopogon citratus.

Benin dietician Elvis Hountodji tell BBC Afrique say "I dey advice pipo make dem mix hot water wit lemongrass, drink am for morning. E dey good for bodi. E dey comot plenti doti."

E add say di mixture dey comot doti from piss. "E dey make you piss plenti" as e add say make pesin wey dey take am no far from toilet but di smell dey make am easy to drink.

Togbé Konou, wey be tradithérapeute for Lomé say, "I remember we bin dey drink dis mixture like tea for morning before we go school. My parents bin dey grow am for house as medicinal herb. E go just dey give sweet smell to di whole yard."

Oga Konou don make many herbal teas for pipo wey dey based on lemongrass. E say, "most pipo dey look dis herb waka pass but e dey work well-well."

Plenti testimones don comot concerning dis plant wey familis dem like to dey plant for yard. Las-las dis na di advice from pipo wey don dey use am.

Wetin di plant be like?

According to di West African Health Organization (WAHO), lemongrass na perennial, short, aromatic herb wey fit reach two metres or more in height.

E come from tropical Asia, wia dem bin plant am as medicine and also as decoration for horticulture. Dem dey grow lemongrass "for slopes to prevent erosion. Becos di roots dey hold di soil kakaraka, e get solid barrier against erosion", according to environmentalist Désiré K.

You fit use lemongrass fresh or e dry becos di smell go still dey dia.

Benefits of lemongrass

Lemongrass

Wia dis foto come from, Getty Images

Di WHO study show say lemongrass fit help in di treatment of candidiasis for patients wey get HIV/AIDS.

Lemongrass get antifungal and antibacterial tins inside am. Elvis Hountodji say lemongrass fit help in di treatment of herpes. E get geraniol wey make am so e fit teat mycoses and sedative fungi. E also get effect wey dey relax pipo.

E say, "lemongrass na real remedy for stress and mental fatigue. E dey fight insomnia to give restful sleep. E also dey work to comot anxiety."

According to many sabi pipo on dis plant, lemongrass na beta regulator of blood sugar levels na why some pipo dey give am to pipo wey get diabetes.

E dey also treat digestive wahala, flu, fever, joint pain and rheumatism.

Di traditherapist tok say, "na plant wey everybodi suppose get for house. E no hard to grow and e dey grow sharp-sharp. I dey give am to my pikin dem dey take am three times a week and true-true e dey do good."

E also advise make pipo wey dey get cough wella make am part of dia daily food especially wen e dey feel like di flu show face.

How to use lemongrass water?

Lemongrass dey make for slow digestion and dey help kidney function.

Dieticians dey recommend for pipo to boil 1.5 liters of water and add 10-15 grams of fresh lemon grass leaves, boil am for 10 minutes.

E dey important to filter am before you drink. You fit drink am hot or cold.

As essential oil, dem fit use am do flit and deodorant. Dem also dey use am for feet sweat.

Lemongrass tea

Wia dis foto come from, Getty Images

Against Mosquitoes

You fit use lemongrass oil as flit or you fit rub am for bodi if mosquito bite you.

Di essential oil wey dem dey take vegetable oil make, suppose dey applied on top pimple 2 or 3 times daily, or spread wia mosquito dey normally bite pesin to prevent am.

Sabi pipo say make una know use dis oil for pikin under six years or for pregnant women.

Di traditherapist say, "I go even say if you plant dis plant for your house mosquito no fit enta becos mosquito no like di nice smell of dis pant. "

Di good news be say lemongrass tea no get side effects, according to sabi pipo. But di oil no suppose dey used by asthmatics or pipo wey get epilepsy, either to drink or as vapour.

Lemongrass oil

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, If you run lemongrass oil for bodi mosquito no go bite you

Uses of lemongrass

Wetin you fit use am do plenti. Some of di best known na:

  • Hypoglycemic
  • Mosquito repellent
  • Purifying
  • Analgesic
  • Antiseptic
  • Aromatic
  • Anti-inflammatory
  • Toning
  • Slimming
  • Purifying
  • Regulating
  • Sedative
  • Bactericide
  • Deodorant

Lemongrass get plenti uses from how dem dey use am cook, to im uses as medicine to treat plenti sickness dem. Dem even dey use am for cosmetic companies too.